Court done close for vacation today, Friday. If dem catch you now, just know say na next year you go see outsideš„ŗ! You fit chop Christmas rice and New Year chicken for cell oš§āāļø! Abeg, behave yourself, avoid wahala/trouble, and if person wan drag matter, just waka dey go.If person step on you, say sorry join.No go do ābig manā for road, oooš!
This period no be time to flex big man or form stubborn. Stay low-key, waka jeje, and secure yourself oooš! Wahala no dey ever finish, so no go look for am. Stay safe ooo!
I just dey talk my own because I love everyone oooooo
